Barack Obama Victory Speech In Pidgin English

Tank una, tank una Tank una, wuna too much o. Dis night so, the work wey we start plenty years wey don pass, na so we go dey carry am dey go forward ever backward never.As e dey go front front so, na because of una o.
Una gree again today say make we don conquer dat spirit for fight fight war and for too much vex. Dat spirit wey don carry dis country from inside of no hope to higher wey plenty hope dey.

The believe wey we get say as every one of us dey run follow our dream so, we still be one American family.  As we dey kampe so eh, na so we go rise together and na so we go fall together like say na one person fall.


Dis night so, for dis election, una don remind me say our waka no easy at all and the road long no be small. 
We don bend down carry ourself up o, we don fight sotay we comot head for road. We sabi for inside our heart say the United States Of America wey pass dem all e still dey road dey come. Me I tank wuna de American People wey come for dis election o. 

Whether na your first time be dis one wey happen now or say you don dey wait tay tay.we go fix am.
To be continued...

6 comments

  1. Hahahahahahahaha, u try weLa. Good job. I like this.

    Thanks for always stopping by my blog

    ReplyDelete
  2. Thank you too o. No be small thing. I go soon complete am finish.

    ReplyDelete
  3. Rotfl. This is so funny
    http://trendysturvs.blogspot.com/

    ReplyDelete
  4. Hey, I wanna follow back should I follow back on this account? Please let me know, :)

    ReplyDelete
  5. Okay I decided to just follow here, LOL. Thanks for visiting my blog

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.