Empress Njamah get tori for you


The Nollywood Actress say make we no dey judge book because of de kind cover wey dem take cover dat book. She say make people dey try open book, clean eye well well look inside the book before dem start to dey give de book some yeye names.

She come talk say plenty people wey never meet her before eh, when dem see her anywhere, take look as her character take good, na so dem dey
come surprise, come dey say ah ah, " Empress, you wey dem say you no good, na so you take kind reach?"  Some people dey even beg am say make she forgive dem for all the bad bad tings wey dem don dey follow talk about her.

Say she no be one waka  about person wey we go dey see every where wey pwople gather. Come add again say she she no dey follow follow dey wey people dey talk everything about nothing.

Abeg make dis long talk no come make me forget say today na her birthday o. Happy Birthday Empress, we wish you long life and plenty prosperity o.

4 comments

  1. mmm......d problem na say dem tooo dey talk their bizness for open so everybodi come dey know their mata.
    If pesin look for publicity, im dey look for tatafo people.
    Happy Baiday to her sha

    ReplyDelete
  2. Yes o Naijamum, you sef dis your language power don pass my own tay tay. Me wey tink say I sabi knack dis our laguage, na im you just dey write am like person wey get degree for pidgin English.
    For empress mata, the moment person go near her, na dat time you go know say no be everything wey press dey write about her be true o. She be one sweet lady o.

    ReplyDelete
  3. Na so lif bi. No bi avery bodi go like person finish. I greet am for im birthday sha. I won people to look sef say e no good to tok bad of person wen you neva sabi wel wel. Na ofofo bi dat one.

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.