President Goodluck Jonathan Brother Don Die O

After people don wish the president Happy Birthday finish, some people sef been still dey try to wish when news come dey waka every where. Daily Times come tell us say the news be say the President im junior brother wey be Meni Jonathan don die. Na for State House Clinic Abuja dem take confirm the death.
Today wey be im Birthday, na the day wey dis sad thing come happen. Make our President gree take our condolence and make the soul of the departed Rest In Peace.

6 comments

  1. eyaa... make im rest in peace o... my condolence to the family.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Thank you Priscy. You do well as you come follow here too.

      Delete
  2. lol,u are a pidgin english guru jare, btw RIP Meni Jonathan

    ReplyDelete
  3. I dey enjoy u.. Kudos! Make d gentle soul rest for peace. And make d family of d departed hold heart. Gbagam

    ReplyDelete
    Replies
    1. Amen. This your "gbagam" come take style swet for ear no be small.

      Delete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.