
After people don wish the president Happy Birthday finish, some people sef been still dey try to wish when news come dey waka every where. Daily Times come tell us say the news be say the President im junior brother wey be Meni Jonathan don die. Na for State House Clinic Abuja dem take confirm the death.
eyaa... make im rest in peace o... my condolence to the family.
ReplyDeleteThank you Priscy. You do well as you come follow here too.
Deletelol,u are a pidgin english guru jare, btw RIP Meni Jonathan
ReplyDeleteFor where, na small small I dey try o.
DeleteI dey enjoy u.. Kudos! Make d gentle soul rest for peace. And make d family of d departed hold heart. Gbagam
ReplyDeleteAmen. This your "gbagam" come take style swet for ear no be small.
Delete