Nollywood Actor Enebeli Elebuwa Don Die Yesterday

 De sick Actor with Actress Ngozi Ezeonu

The actor die for India. For de hospital wey dem dey give am treatment. Channels news website dem report say Enebeli don dey sick since about one year now. E get time wey one pastor Sign Firemen been come out say him don
heal the Actor o. Sotay dem post de video of de Actor as e dey struggle to waka for ground. 

After sometime now, im family come tok say na lie. Say de man never heal Enebeli. The Governor of him state come help fly am go India for treatment. Yesterday,  Channels come report say him don die.

May im soul Rest with God o!

4 comments

  1. Aww... May his soul rest in PEACE.

    ReplyDelete
  2. sisi,i hear the news and e pain me...rip sir
    anyway how u dey?
    www.somewhereinmoscow.blogspot.com

    ReplyDelete
  3. D mn reminds me of my Daddy hoping 2c him somdy ....RIP Mr

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.