Goldie Harvey Don Go Rest Be Dat





Today, Goldie dead body don go Rest. Since that Valentine's Day wey be 14th of February wey we hear say Goldie don die, I never stop to dey run water for my eye. I don try to
carry my head comot from dis kind  die body News, but e no work at all.

If person tell me say I go cry like dis for Goldie, I no for gree. Why? be say, since Big Brother house, me sef I follow dey talk about how Goldie come dey fall our hand for inside Big Brother House. I even follow sef dey talk say make Prezzo leave our Goldie for us o. After all that Big Brother house talk, I come see say I don dey like Goldie. Especially when we hear say Prezzo come Nigeria dey call Goldie for fone. We hear say Goldie dey make guy for prezzo. say she no dey even answer him call sef. That one come sweet my belle with Goldie sotay I come dey like am well well.

The shocking News say she die come weaken all my bones, I come see say this life true true na vanity, nothing dey inside.

As Goldie don finally go rest today, I pray say make papa God help her family and friends dem, to fit carry dis heavy load.

The tribute wey her Oga Andrew Harvey and Her Best Friend Denrele write for Goldie. I go do am for pidgin after, so dat we too go take read am for our Naija Pidgin.
Goldie, Make you continue to dey Rest  With Papa God.
Enhanced by Zemanta

No comments

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.