I Buy Water, NO CHANGE, Enter Bus, NO CHANGE, Pay Okada Bike, NO CHANGE, Na Wetin?

Nigerian currency, why getting change is now over difficult... E no easy to collect change from any seller hade at all at all.
Plenty buses dey load for Area one park, I come waka go near de one wey don dey full, wetin I hear na "wuse! Wuse! Wuse!" Then pause. The bus conductor start again, " Wuse, enter with your change, enter with your change. I look inside my bag na only #1000,00 bill dey inside:) Na how I wan take enter hundred naira bus with my change for pocket?

Before, before, when you buy something, na de seller go find change for you. Now, before you ask how much? for any item, the seller go just quick quick ask if you hold your change. Sometimes sef, when they ask if you get change, na to collect your money settle another customer wey don dey wait in queue. You go now do better person, help dem with de change. Then, when your turn come reach, na so you go don tire to wait for change, so, you kuku tell the trader make e keep the change. Lol.

Dis keep the change ting, don take style spoil some market sellers and some shop attendant dem. E kuku don reach mallam dem too sef, wey be say now if you buy something and your change dey less than hundred naira, or say na from hundred down, forget the change o, because if you try to wait eh, you go wait tire. 
At the end of the day sha, these traders go don make cool money from... NO CHANGE!

So, me I
dey ask o, what of the money wey dem sell the previous day? dem no fit carry de small small cash come keep for shop as change? Or sef collect plenty change from church on sundays na. Truth be say eh, we wey dey buy nor dey know but de solemn truth o, at the end of your shopping day, you go don leave change for people hand running into some thousands of naira. Them too go don keep change from buyers hand  running into thousands. People wey get dis cunny cunny sense go don rich from ...NO CHANGE.

Wetin come make to get change come dey hard like dis sef? e be like say eh, very soon, before you go market or enter taxi, you go first of all find all their change put for pocket o. Abi Central Bank nor dey print small small denomination for Nigerian currency again?

4 comments

  1. Me sef I tire 4 dis no change tin. I b lawyer. Wen I go court go do wetin we dey call filing, na so d court clerk go tell U say 'no change'! Even if na N200 change sef, dem go say still no change @ d end I go jus vex leave am behind. Som days eh, I go leave up 2 N800 change behind! I don com think am say may b dem dey do am deliberately take am take dey make cool cash carry go house!:|:(

    ReplyDelete
    Replies
    1. My dear De Law, No be lie o. Dem dey make serious cool cash.

      Delete
    2. Don't mind them, another means of extorting money from people, every day comes with new strategy in naija.

      visit us @
      www.spillithere.com
      share your story
      Eya thanks!

      Delete
  2. I read your blog frequently and I just thought I’d say keep up the amazing work! campers for sale in Missouri

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.