Who Say Nollywood Actor Mike Ezuruonye Dey Bleach? Ehn? Na who?

Mike Ezuruonye and him small pikin wey e dey call 'mini me'
Well, for busy body dem wey sabi like to dey gossip celebrities for twitter. Mike just upload this picture of him and im boy to ask the tatafo whether the small fine boy too dey bleach? Since the bobo even yellow pass im father.
Because im family dey New York now dey
enjoy correct weather no mean say im skin for remain like when e dey suffer dis our naija hot sun o. Mike before before na fair guy, den e come go obodo oyibo again wetin you think say im skin for look like? no be oyibo skin?



3 comments

  1. Eya wetin do wives connection blog biko? Since ds wk d blog dey show epic stories and food wey we Don treat finish. As I say mek I type wives connection with today's date na so google carry me com here.
    answer abeg mek I.no wetin hapn weda na my phone causer abi na u b d causer?
    Weldone o!

    ReplyDelete
  2. Abeg no vex, you know say dis blog don dey patient for long o. Everyday bna so I go dey cook take post for wives connection so tay dis pidgin English blog come dey cry say I don abandon am. As I born now I never start to dey cook by myself so dat I go take post for wives connection na im I say make I take style visit dis one wey don dey catch cold.

    ReplyDelete
  3. Pls come back to wives connection, we dey gbadun u for DAT place Jo. Wot of other story apart Frm cooking.

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.