Welcome To Naija Pidgin English Blog: Nigerian celebrity pidgin english news

Showing posts with label Nigerian celebrity pidgin english news. Show all posts
Showing posts with label Nigerian celebrity pidgin english news. Show all posts

SEE HOW HOT MAMA DEM ANNIE IDIBIA AND KAFFY CARRY THEIR CHILDREN TAKE DEY BOUNCE FOR RUNAWAY?



Na for dis African Fashion Week wey hold for Lagos dem take do dis correct waka.
Up there na Kaffy and her fine son , if you look down na Annie and her baby girl picture you go see...
0

Una Still Dey? Happy New Year O, How Sunday?

Chai, I don already share dis one for wives connection before I come remember say na here be the proper place for dis laughter. 
Dem say Boko Haram don poison beans after I don buy half bag keep for house. From the one wey I cook, I give my dog, Bingo, make im first test am. 45 mins later, bingo still dey waka, dey jolly. Na im I come chop my own. After I don chop finish, my gateman run come tel me say bingo don die, hey! I run
0

Our Mercy Johnson, No Let Person Fall Your Hand Or Blow Your Candle o

Our Pregnant Mercy Johnson wey no gree act for us again o
Dis post na because of vex do me dey write am o. As I go read Mercy Johnson Post finish. I like as she chose to dey rest with dis her second pregnancy. The first belle, she work wella, even come resume maternity leave as soon as she and baby purity enter Nigeria. Maybe some people no like as she dey work hard, na im dem come say ''dem no go never marry husband wey go release dem go dey hussle quick quick after labour room''
 As the Nolly wood actress 'poko' talk dis ting finish, me I no tink say e fit make Mercy Johnson come go sidon for house when de number two belle come enter o.

As soon as de goal score for her belle, we come hear say she wan take leave go sidon for house until pikin come. No be so na, we sabi say even if you no work, oga fit put food for your table even in the poresence of your enemies, so, you no need to prove anything my dear. Acting work dey so like mathematics, if you leave am for one day, e fit leave you for two days, and, as upcoming actresses dey rise everyday for Nollywood, person fit just take your place before you enter again:)

Well, if na because say Doctor prescribe bed rest, den no problem, but, if na say because person mouth do yabis, say you wan
1

Beauty Dey Linda Ikeji Family DNA

Laura Ikeji, see as her slim figure come resemble barbie sef
My people how we dey na? E don tey wey I never update this blog o. God dey!
Na cooking and posting for wives connection blog we go blame sha. As I born now, I never start to dey cook so make I take style enter this area.
Linda Ikeji small sister Laura, wey sabi show us everything wey Linda sef dey hide, like the new car for her manager and her rolex watch and
6