Welcome To Naija Pidgin English Blog: Pidgin Phone reviews

Showing posts with label Pidgin Phone reviews. Show all posts
Showing posts with label Pidgin Phone reviews. Show all posts

Between Nokia Lumia And Samsung Phone Dem, Na which One Better Pass o?

Na which one of dis two phone dem better pass abeg
Wetin make me ask dis question na because say, as I be blogger, I dey always try to blog with any phone wey dey my hand. Like wen I still carry belle o, I no come fit sidon again with laptop, na phone dem help me dey update my wives connection blog. Na since dat period I come see say no be all phones dey do wetin person want, and, na den I come know say before person go buy phone for market, e good make you ask yourself wetin you need dat fone for?

When you answer your self, dat answer go lead you to buy de real phone for yourself. No be say because everybody dey carry Blackberry you sef go run go buy am and den when you reach house you come discover say dat no be wetin you need.

As I been dey talk before sha, I try to blog with plenty phone, den, I come see say to blog with Nokia no easy like when you blog with Android. Android phones just dey do the work like say na behind laptop person sidon but with my Nokia, Lumia for dat matter o, no be Nokia 3310 wey I been dey use before:)s, na Lumia wey be say dem tell us say e sabi work for person like magic, na im wey when I open my blog, some things go show, while others no go gree show. To even open my Google mail for there, e no gree at all till tomorrow.

Abeg, if you don
2