Welcome To Naija Pidgin English Blog: mercy johnson

Showing posts with label mercy johnson. Show all posts
Showing posts with label mercy johnson. Show all posts

Our Mercy Johnson, No Let Person Fall Your Hand Or Blow Your Candle o

Our Pregnant Mercy Johnson wey no gree act for us again o
Dis post na because of vex do me dey write am o. As I go read Mercy Johnson Post finish. I like as she chose to dey rest with dis her second pregnancy. The first belle, she work wella, even come resume maternity leave as soon as she and baby purity enter Nigeria. Maybe some people no like as she dey work hard, na im dem come say ''dem no go never marry husband wey go release dem go dey hussle quick quick after labour room''
 As the Nolly wood actress 'poko' talk dis ting finish, me I no tink say e fit make Mercy Johnson come go sidon for house when de number two belle come enter o.

As soon as de goal score for her belle, we come hear say she wan take leave go sidon for house until pikin come. No be so na, we sabi say even if you no work, oga fit put food for your table even in the poresence of your enemies, so, you no need to prove anything my dear. Acting work dey so like mathematics, if you leave am for one day, e fit leave you for two days, and, as upcoming actresses dey rise everyday for Nollywood, person fit just take your place before you enter again:)

Well, if na because say Doctor prescribe bed rest, den no problem, but, if na say because person mouth do yabis, say you wan
1