Between Nokia Lumia And Samsung Phone Dem, Na which One Better Pass o?

Na which one of dis two phone dem better pass abeg
Wetin make me ask dis question na because say, as I be blogger, I dey always try to blog with any phone wey dey my hand. Like wen I still carry belle o, I no come fit sidon again with laptop, na phone dem help me dey update my wives connection blog. Na since dat period I come see say no be all phones dey do wetin person want, and, na den I come know say before person go buy phone for market, e good make you ask yourself wetin you need dat fone for?

When you answer your self, dat answer go lead you to buy de real phone for yourself. No be say because everybody dey carry Blackberry you sef go run go buy am and den when you reach house you come discover say dat no be wetin you need.

As I been dey talk before sha, I try to blog with plenty phone, den, I come see say to blog with Nokia no easy like when you blog with Android. Android phones just dey do the work like say na behind laptop person sidon but with my Nokia, Lumia for dat matter o, no be Nokia 3310 wey I been dey use before:)s, na Lumia wey be say dem tell us say e sabi work for person like magic, na im wey when I open my blog, some things go show, while others no go gree show. To even open my Google mail for there, e no gree at all till tomorrow.

Abeg, if you don

Who Say Nollywood Actor Mike Ezuruonye Dey Bleach? Ehn? Na who?

Mike Ezuruonye and him small pikin wey e dey call 'mini me'
Well, for busy body dem wey sabi like to dey gossip celebrities for twitter. Mike just upload this picture of him and im boy to ask the tatafo whether the small fine boy too dey bleach? Since the bobo even yellow pass im father.
Because im family dey New York now dey

Beauty Dey Linda Ikeji Family DNA

Laura Ikeji, see as her slim figure come resemble barbie sef
My people how we dey na? E don tey wey I never update this blog o. God dey!
Na cooking and posting for wives connection blog we go blame sha. As I born now, I never start to dey cook so make I take style enter this area.
Linda Ikeji small sister Laura, wey sabi show us everything wey Linda sef dey hide, like the new car for her manager and her rolex watch and

Listen To Nigerian Pidgin English Tori about The Pope's New Name




Since wey we hear say Pope Benedict XVI wan resign from him big chair wey e siddon, some people like even me sef, we come dey tink say na just to change name be de mata. We no know say plenty tings dey follow change. Plenty tings dey wey don change now,

Before Na Benedict XVI, Now Na Emeritus Pope We Dey Call Am O

English: Pope Benedict XVI in St. Peter's Squa...
English: Pope Benedict XVI in St. Peter's Square, Rome (Photo credit: Wikipedia)
Since wey we hear say Pope Benedict XVI wan resign from him big chair wey e siddon, some people like even me sef, we come dey tink say na just to change name be de mata. We no know say plenty tings dey follow change. Plenty tings dey wey don change now, so, as him no come be pope again. The ones wey me I fit remember be