Nollywood Actor Enebeli Elebuwa Don Die Yesterday

 De sick Actor with Actress Ngozi Ezeonu

The actor die for India. For de hospital wey dem dey give am treatment. Channels news website dem report say Enebeli don dey sick since about one year now. E get time wey one pastor Sign Firemen been come out say him don

Actor Joseph Benjamin Marriage no dey Again


The Nollywood Actor and Television Presenter himself carry im mouth talk for one interview for Reel Radio day before yesterday say the marriage don scatter. E say him and im wife get two pikin together. The girl don reach ten years while de boy na seven years e be.

President Goodluck Jonathan Brother Don Die O

After people don wish the president Happy Birthday finish, some people sef been still dey try to wish when news come dey waka every where. Daily Times come tell us say the news be say the President im junior brother wey be Meni Jonathan don die. Na for State House Clinic Abuja dem take confirm the death.

Empress Njamah get tori for you


The Nollywood Actress say make we no dey judge book because of de kind cover wey dem take cover dat book. She say make people dey try open book, clean eye well well look inside the book before dem start to dey give de book some yeye names.

She come talk say plenty people wey never meet her before eh, when dem see her anywhere, take look as her character take good, na so dem dey

Justin Bieber And Selena Gomez Don Cut Tear Comot O

From wetin I read dis morning, The two of dem no come dey see well well as lovers suppose because dem too dey work and travel the world. For Relationship like dat to last, the two people dem suppose dey find time sidon, tori, laugh, play no be small. But for Selena and Justin Bieber life, work too much.

Barack Obama Victory Speech In Pidgin English

Tank una, tank una Tank una, wuna too much o. Dis night so, the work wey we start plenty years wey don pass, na so we go dey carry am dey go forward ever backward never.As e dey go front front so, na because of una o.
Una gree again today say make we don conquer dat spirit for fight fight war and for too much vex. Dat spirit wey don carry dis country from inside of no hope to higher wey plenty hope dey.

The believe wey we get say as every one of us dey run follow our dream so, we still be one American family.  As we dey kampe so eh, na so we go rise together and na so we go fall together like say na one person fall.

Na Wetin Tonto Dikeh Do una Now? Abi Na Bad Belle?

Since wey Tonto announce for her twitter page say she wan release her own music for market, na so people and even her fans just dey laugh say who dash Tonto voice wey fit sing sweet song? Some people no even end for there o, dey come dey talk say Tonto no even sabi act for movie. If any body talk say Tonto no sabi act eh, me I no gree o. The only thing with her be say she no send. She no dey hear word and even the role wey be say all the women actress dem no get liver to act, na dat

Na One Billion People Dey Use Facebook Now. Shine Your Eye O!

The Oga wey start Facebook, Mark Zuckerberg don announce say de number of people wey dey use Facebook don reach one billion o. Where you hear dat one before? Say a whole one Billion people go dey use one Tori Meeting Place. Na only Facebook fit do dis king ting. 
Why de number no go plenty? Almost everybody wey dey use Internet want to join Facebook. Whether na for computer or phone o, e no matter.

As plenty people dey join Facebook now, make we no forget say any where good thing dey, na so bad one too dey join put am o. Plenty of us join dis Facebook to

Actress Uche Jumbo Never Plan To go Live With Oga


 Jumbo still dey for Naija since wey she and her Ogs Kenny Rodriguez do their wedding. De actress say she no want to go dey live with oga for New York. She talk say na

Tief Don Enter Lagbaja House o



The Ojuju Calabar singer himself no even dey country when dis tief take happen. Im travel overseas. De Arm Robbers dem break

Bishop David Wan Drive Him Wife Comot


Bishop David Benenoch and im wife dem don dey marry for twenty years now. Dem even get three pikin add join for de marriage. People wey know dem dey talk say him and im wife start dat church Communion Church Worldwide for one open place like dat. Now de church don big come get plenty members. 

For sunday service, as de Pastor Stand for up dere, na so im just announce tell im members say e want divorce im wife. Divorce be

Justin Bieber Don Vomit For On top Stage


Dis Justin Bieber na musician wey be say e sabi sing well well. One ting wey you fit no sabi about am be say among all de people wey every body dey find for internet. Among all de better better celebrity dem. Na Justin Bieber name wey people dey search pass for internet o. For people wey tink say na President Barack Obama or Oprah Winfrey. Na lie o. Justine Bieber name carry first position. Everyday, na million

Empress Njamah Don Say "Nothing For Timaya"


As people see Empress and Timaya dey dancs for Tuface Idibia Birthday Party for Lagos, na so plenty mouth come dey run dey talk say e be like say Empress don settle with her former bobo Timaya. She don come talk say dat dance wey

Saudi Arabia Don Drive Some Pilgrims Comot

 

De Govment of dis country say wetin make dem drive some of dis women pilgrims go back home na because say dem no follow de law. Their law for dat Kingdom be say, any woman wey wan come for Hajj, if e know say im age never reach 45, make e kuku carry one man pikin follow am come.

No be any kind man

Man Pikin Don Turn To Car Seat O



Dis Africa man don tire with life for dis African continent sotay him come ready to do anyting wey go just carry am comot from him country Guinea. As e tink finish, e come go plan with two Moroccans on how dem fit help am run escape. As you see am inside dis car, na so dem take construct space for am like car seat. Another man come climb sidon on top am like

Papa Beat Mama, Pikin Kill Papa With Knife


This one no happen for Naija o. E no even happen for Africa. Na for Philippines. Me I never go there before but I dey see dis name for Bible. The thirty eight year old papa sabi find woman well well. As im dey find woman, na so im wife dey fight am everytime. 

According to wetin deir neighbour tell Police, " dis family dey fight eh,  no friday dey pass wey Oga and madam no dey fight"  Dis man like woman sotay dem don drive am comot for two places wey him dey work, because him office

Kai! See As Kelechi Dey Sleep With Goat


Dis one na for Ebonyi State e take happen. Kelechi Nnali wey get two wives with pikin dem go bend down dey sleep with small sheep for corner road. One small boy come catch Oga Kelechi as him dey do am with de sheep. E come dey beg de poor boy say make e no tell anybody, come say him go give de boy ten thousand naira with fine handset .. The boy wait small, come see say e be like say na deceive Kelechi don deceive am so. 

The boy just run go spill the beans for de elders dem ear. The matter too serious for dem ear, de no even know wetin to do, so dem take Kelechi go for Ogo Ezinwachi Playground wey dey for de community. Na with vex dem tell say de ting wey him do with dat sheep na abomination. Now my head dey tell me say person wey go chop dat meat anyday dem kill de sheep, go don chop Kelechi blood. 

If Kelechi himself come go sleep with im two wife dem, dat one be say na sheep blood e don transfuse give dem o. Abeg na who go help tell us wetin fit make Oga wey marry go dey sleep with sheep or even goat sef.??

Police Wey Catch Cynthia Osokogu Killers Dem Don Smile O



Friday wey just pass so, wey be September 21, The National Orientation Agency Come Reward The Policeman dem wey investigate sotay dem come catch the yeye men wey Kill the Fine Cynthia Osokogu. 

The Directof For National Orientation Agency say wetin make am come honour dis policemen dem na because sau dem work well well. If no be dem, we for still deyn hear say they never find the people wey kill Cynthia. You know say na so e dey happen for our Naija. Wen dem kill Person, Police go dey say dem still dey look for the killers until we forget about the person wey die. For dis Cynthia case, everybody happy with Nigerian Police because sharp sharp dem investigate, sharp sharp dem catch the yeye men dem and sharp sharp dem carry dem go court.

The Seven Police Officers na:

Na Timaya And Empress Njamah Tory


People wey go for Tuface Idibia him Birthday Party wey hold for Lagos dem see Timaya and Empress Njamah dey dance together o. Dis na their first friendly time since wey dey break up. After dat break up, we know say Timaya come dey talk say make Empress give am back the car key for the motor wey him buy dash Empress. Sotay Timaya come call Empress Thief. Come say Empress hand dey quick well well. The thing vex de Actress well well o.

Since dat time till now, people never see dem together o. Sotay Timaya come born pickin with im baby mama this year. Dat 18th of September wey be Tuface Idibia Birthday Party, no be say dem come the Party together o. Empress first reach there before Timaya, she kuku find her

Teachers For Lagos Dem Don Strike O



Teachers for Lagos State Dem begin the strike today because of say The Government of Lagos never start to dey pay dem the 27.5% Teacher Salary Structure wey Government been agree to pay dem. Dem dey vex with Government and don say no one teacher go start work until Governmet do wetin e promise dem.

Na Wetin Dey Happen To Mama?

English: Demonstration of bad food hygeine in ...
English: Demonstration of bad food hygeine in stored foodstuffs in a refrigerator (Photo credit: Wikipedia)
Abeg who know Wetin dey happen with our president wife? Dame Patience Goodluck Jonathan,  E don stay wey we hear say she no well, some people say na food poisoning, others say na appendicitis wey come burst inside her belle. Some of us come even hear say she don well, say na the German Doctor dem say make she wait small time before she return back home. After dat

Na Naija Food Make Our Woman Dem Come Dey Fat

Vegetable beef barley soup
Vegetable beef barley soup (Photo credit: Wikipedia)
Today morning, I tell myself say this too much of carbohydrate eating must stop! Na so my weightloss just dey fluctuate because anytime I lose weight, rice, yam, garri, semovita, plantain, cocoyam wateryam, cassava, dem no dey let me maintain the slim body. 

Today slim, tomorrow big! na wetin? Day no go pass wey person no go chop one of these carbohydrate food dem. If you say you want take tea for morning, na so the bread go carry carbohydrate load for your body. If you come say Ok for lunch make you eat vegetable soup, na so the pounded yam or eba go just load carbohydrate for your body.

For dinner now? Ok tell me wetin person wan chop wey no carry plenty carbohydrate inside? You fry your egg o, na only dat one go take full your belle? You chop only fruits and vegetable dem, na so belle go just dey make noise for night like say you never eat for three days.

People dey talk say for recent years, Nigerian women come too dey fat. If almost every meal wey we eat na heavy one, how the weight wan take reduce? Abi make we no chop again kpata kpata? make we just dey drink only water? how we wan take survive?

WHY E HARD TO LOSE WEIGHT

  1. The cost of fruits and vegetable no gree person rest. You need plenty thousand naira everyday before you go fit buy small fruits from market. If you buy ordinary pineapple, pawpaw, apple,oranges, coconuts,and some small vegetables like watermelon, cabbage, peas, green beans and others, you go discover say the thousands wey you don spend for reach you cook three pots of afang, edikang Ikong soup or even six pots of ewedu soup. After you don buy the fruits dem come your house, na dat time everybody inside house go know say e dey important to eat fruits. dem go just finish the fruits like say na fruit eating competition wuna dey do.  

  2. Family dey take almost all the time wey woman get. As soon as you wake up for morning, if you get family, you don dey alredy plan for breakfast, lunch and dinner. Prepare the ones wey wan go school, come start to dey hurry for yourself. Your own body go dey carry last every time say you wan please your family first abi?

  3. I must swallow! For plenty of us naija women, if we no swallow fufu of anykind for one week, we go fall sick. The swallow na sos so carbohydrate full inside. If we take plenty soup with small eba, e go help us lose small weight, but for where? the fufu must to big while the soup small. Abi na lie? 

Enhanced by Zemanta