Beauty Dey Linda Ikeji Family DNA

Laura Ikeji, see as her slim figure come resemble barbie sef
My people how we dey na? E don tey wey I never update this blog o. God dey!
Na cooking and posting for wives connection blog we go blame sha. As I born now, I never start to dey cook so make I take style enter this area.
Linda Ikeji small sister Laura, wey sabi show us everything wey Linda sef dey hide, like the new car for her manager and her rolex watch and
everything showable, I like her, cos with her we get to know Linda more than she want sef.  Once you visit Laura's Instagram page, you go see tire, neck go pain you before you even look half.
Image courtesy: her senior sister blog LIB
I like say she wan start her own reality show and that one go be drama, drama, drama cos Laura no quiet like Linda o, she na Proper Naija babe wey if you give her mouth, she give you back sharp sharp. Her promo pics show say fine dey day family body well well. Unlike her senior sis,Laura never do any modelling before o, but see beauty na.
I dey try to remember oyibo movie wey get this pose, kai I don forget abeg

I really wan to know when dat reality show go start!

6 comments

  1. Lol. Eye, u go killi me o. So, we go soon start to dey 'keep up with LIB small sis'? She deck sha - see that pose!

    ReplyDelete
    Replies
    1. odikwaegwu!

      visit us @
      www.spillithere.com
      share your story
      Eya thanks!

      Delete
  2. Mtscheeeeeeew,aunty Eya abeg try chill with the hype.dis girl na original mgbeke biko.

    ReplyDelete
  3. Which work she dey do?

    ReplyDelete
  4. Sharon Stone pose !
    Won't mind a keeping un with the Ikeji's !!

    ReplyDelete
  5. Sharon Stone pose !
    Won't mind a keeping un with the Ikeji's !!

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.