Our Pregnant Mercy Johnson wey no gree act for us again o |
As the Nolly wood actress 'poko' talk dis ting finish, me I no tink say e fit make Mercy Johnson come go sidon for house when de number two belle come enter o.
As soon as de goal score for her belle, we come hear say she wan take leave go sidon for house until pikin come. No be so na, we sabi say even if you no work, oga fit put food for your table even in the poresence of your enemies, so, you no need to prove anything my dear. Acting work dey so like mathematics, if you leave am for one day, e fit leave you for two days, and, as upcoming actresses dey rise everyday for Nollywood, person fit just take your place before you enter again:)
Well, if na because say Doctor prescribe bed rest, den no problem, but, if na say because person mouth do yabis, say you wan
show de person say you fit survive without acting, den, no be sense be dat o.
I no empty my belle finish for LIB, dats why I come to hide here rant jor!
I don rant my own finish be dat.
true talk Eya, she just diappear kpatkpata!
ReplyDeletevisit us @
www.spillithere.com
share your story
Eya thanks!