Justin Bieber And Selena Gomez Don Cut Tear Comot O

From wetin I read dis morning, The two of dem no come dey see well well as lovers suppose because dem too dey work and travel the world. For Relationship like dat to last, the two people dem suppose dey find time sidon, tori, laugh, play no be small. But for Selena and Justin Bieber life, work too much.
As Selena dey waka dey do her singing work, na so Bieber dey waka for him own too. Because of dis plenty no dey see for eye, na im the two come sear oya now make we kuku tear comot. Make every one go im own way. Relationship wey people no fit see each other for eye, na how dem wan take maintain dat relationship? E no easy at all.

As I read am for Linda Ikeji finish, na so I come say well I wish dem well o.

12 comments

  1. Hi Linde, you are welcome. I am going to follow you now.

    ReplyDelete
  2. Yes. Thank you. Once you follow me, my follow back is 100%.

    ReplyDelete
  3. LOL! Your headline had me in stitches. Nice one here:)

    ReplyDelete
    Replies
    1. Thanks for stopping by Shaday. Your letter to yourself is quite interesting. Do come again.

      Delete
  4. You don try wella Joy! I go dey reach this site! Thumbs up!!!LOL!
    http://nitabrownsugah.wordpress.com

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hi Nita, thanks for stopping by. Congrats on you upcoming wedding and FYI I just signed the guest book. Make you dey come visit o.

      Delete
  5. LOL you are a way with words!!! I love this post

    Thanks for visiting my blog!! LOL

    ReplyDelete
  6. This na correct blog wey make sense.As e be say na blog wey dem dey knack the language wey i like.Carry go jor!

    ReplyDelete
  7. hahaha,ur pidgin no get part 2
    somewhereinmoscow.blogspot.com

    ReplyDelete
  8. Hahaha, I just dey land from Moscow now now, sotay I don follow sef.

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.