Tank una, tank una Tank una, wuna too much o. Dis night so, the work wey we start plenty years wey don pass, na so we go dey carry am dey go forward ever backward never.As e dey go front front so, na because of una o.
Una gree again today say make we don conquer dat spirit for fight fight war and for too much vex. Dat spirit wey don carry dis country from inside of no hope to higher wey plenty hope dey.
The believe wey we get say as every one of us dey run follow our dream so, we still be one American family. As we dey kampe so eh, na so we go rise together and na so we go fall together like say na one person fall.