Una Still Dey? Happy New Year O, How Sunday?

Chai, I don already share dis one for wives connection before I come remember say na here be the proper place for dis laughter. 
Dem say Boko Haram don poison beans after I don buy half bag keep for house. From the one wey I cook, I give my dog, Bingo, make im first test am. 45 mins later, bingo still dey waka, dey jolly. Na im I come chop my own. After I don chop finish, my gateman run come tel me say bingo don die, hey! I run
enter house, begin drink full gallon of palm oil for my belle, chop 22 bitter kola wit 3 long bitter leaf stem, chop walnuts with the shell no time to crack, swallow moringa with aloe vera as treatment combo. Garlic and onions be like sweet for my mouth. I come dey sweat as if na oven be my bedroom. I dey think say my life don finish. I come outside. Na im gate man com they tell me say the driver wey kill bingo wan come beg me!

No comments

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.