Na One Billion People Dey Use Facebook Now. Shine Your Eye O!

The Oga wey start Facebook, Mark Zuckerberg don announce say de number of people wey dey use Facebook don reach one billion o. Where you hear dat one before? Say a whole one Billion people go dey use one Tori Meeting Place. Na only Facebook fit do dis king ting. 
Why de number no go plenty? Almost everybody wey dey use Internet want to join Facebook. Whether na for computer or phone o, e no matter.

As plenty people dey join Facebook now, make we no forget say any where good thing dey, na so bad one too dey join put am o. Plenty of us join dis Facebook to
help us make we dey nack tori with our people wey dey far far and to find some of our old friend wey we no dey see again. Others dey join to look for who dem go carry go kill. Some dey even join so dat dem go find people wey go fall mugu for dem make dem tief deir money for bank.

Na How People Dey Carry Fall Mugu For Tori Place Like Facebook?  

  1. Wen Person ask dem for chat say where dem dey live?  na so dem go just open mouth dey say "I live for Number 25 Balogun Street. For dat house with white gate."

  2. Wen Person tell dem say him don tief plenty amount of money and e dey find where to hide the money so dat dem go share am fifty fifty, na so dem go just chat back quick quick say na which of my account number you need? na de one for Intercontinental Bank abi na de one for Mercantile Bank you want, or sef I fit just give you the two account numbers so dat de one wey dey closer to you, you just pay de money inside. After dem don give all dat personal information finish, de next day dem discover say de small one thousand naira wey been remain inskide dat account number don kukuma disappear. *Olodo* sorry!

  3. De way wey some people dey take fall mugu for Facebook eh, friend of friend wey no even sabi dem go dey ask plenty question and na so dem go dey answer o until e come reach de level wey be say de person go ask how we go take see now? 

     I get small money wey I want give you make you take know say I like you wella. Dem go just happy come dey tell de person say " I fit come your house now come collect de money, just send me de address and tell me which time wey you go dey for house. *mumu* If you come go for dat house and de person come lock im door say "today na today, dis your head I go cut am comot with dis my sharp matchete," wetin you go do? When e don cut de head finish, na so people wey dey try to find small garri to chop, go just abandon all deir work come dey look for missing person and dey cry and do fasting and prayer. E good so?

  4. Sometimes sef. Person go see say you write for your profile say na amariah you be, yet e go tell you say. Make you leave your oga come marry am because im like you pass your oga. 

  5. Others, de moment person just say hello baby, na so dem go just smile come dey remain for dat chat sotay dem no go remember to cook food on time for de family again.
Abeg, make we try not to dey fall mugu for Facebook again o. If we want give out information about ourself, make e be de kind ting wey you fit talk for public o. Make e no be your personal tori o.

Some Secondary School users sef eh, na dem dey fall deir mama and papa hand pass. As deir parent don comot go work, na so de  go stand for all de rooms wey dey inside house dey take pictures dey post for Facebook. Wetin? Abi your mama and papa house don turn to public building? Wetin you no know be say even your enemy and bad people dem go see dat photo wey you dey put so.

Any need make we leave some Tings For Private? 

My answer na Yes o. E good well well make we dey get small ting wey oyibo man call mystery around us. Even celebrity sef dey try to hide deir family life and privacy from public shine shine eye. Why e go be say na we go sell all our small privacy wey be say na our right. Sell am all give public. Kidnapper wey wan tief your pickin no go even suffer to try to know de pikin. Once e see your Facebook page, e don see everyting for your life. No be say e bad to show our friends wetin dey happen for our life o. De only ting be say e good to hide some tings from public shine shine eye. Abi na lie I talk?

5 comments

  1. my sister,no be lie u talk o....d thin wey dey 4 dis our country ehn.. Na only God fit save us.....Make all of us shine our eye o

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hi Platinum7, tank you o. My own eye don start to dey shine already.

      Delete
  2. "Wetin? Abi your mama and papa house don turn to public building?" Laff wan kill me die. Tomoro wen thif go come dia house, dem go dey shout pass mad man.
    Dis facebook mata plenti plenti.

    Madam Joy i like this your pidgin tori wellu wellu. You come funny join am. Chop knuckle. Thank you wellu wellu for visiting/commenting. I hope say i go dey see more of you.

    ReplyDelete
    Replies
    1. @Ginger, you do well as you come visit me o. No worry I go dey stop by when I drive my online motor pass near your neighborhood. Make you no laugh my dear, de kind ting wey children dey do for Social Networking sites eh. dem no even know say their privacy still dey important o.

      Delete
  3. lol
    mugus, all of you

    make you stop pretend to be oyibo, go push truck like true igbo/yoruba/etc

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.