Na Wetin Tonto Dikeh Do una Now? Abi Na Bad Belle?

Since wey Tonto announce for her twitter page say she wan release her own music for market, na so people and even her fans just dey laugh say who dash Tonto voice wey fit sing sweet song? Some people no even end for there o, dey come dey talk say Tonto no even sabi act for movie. If any body talk say Tonto no sabi act eh, me I no gree o. The only thing with her be say she no send. She no dey hear word and even the role wey be say all the women actress dem no get liver to act, na dat
one wey Tonto dey like act pass. 

From de first time wey me I see Tonto for TV, wey dem dey compete for de next movie star. If you ask me make I choose the winner dat time, na Tonto me I for pick because she been take time shine for there. She dey make up her face come look fine like small mami water. She been look very unique and different from other contestant dem. Since dat time till now, even though say I no like some of her roles wey she dey act, that one no mean say Tonto na bad actress. She sabi act even over act sef if dat kind one dey. 

Plenty people dey like to talk about Tonto because say when she hear say person mention her name eh, she dey reply back sharp sharp. She no dey waste time to tell you her belle. Since this week wey she release her two songs, even though the download for youtube don pass one million, People still dey download no be small, but even as dem dey download dey go, na so dem dey rubbish the song dey go. 

Many bloggers put the songs for their blog for people to hear. When dem hear finish, na so so rubbish comment dem just dey leave behind. comments wey dey rubbish both her voice and the lyrics. Me now I come dey even fear to go Youtube to hear de song. Because of the too much bashing of Tonto, I no even come get liver to search for the song again. Na wetin Tonto Dikeh do o?

2 comments

  1. Hahaha this was hilarious. Is the song that bad? I haven't had the time to check it but I sure have heard the so many derogatory comments.
    Eh yah poor her!

    ReplyDelete
  2. Heavy bad belle,lol
    http://trendysturvs.blogspot.com

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.