As people see Empress and Timaya dey dancs for Tuface Idibia Birthday Party for Lagos, na so plenty mouth come dey run dey talk say e be like say Empress don settle with her former bobo Timaya. She don come talk say dat dance wey
dem dance na because dem meet for party o. say nothing dey happen.
People wey dey talk so eh. So if person ask you say make you follow am dance for party, na so you go open mouth tell am say "go sidon, because me and you we no be friend again?" Abeg Empress don pass dat small pikin level o. She no fit shame person for party say because dem get small quarrel. Na only dance dem dance. You hear? Kai, see as Empress take time fine for dis picture.
No comments
You do well as you read am. Oya add wetin you tink.