Papa Beat Mama, Pikin Kill Papa With Knife


This one no happen for Naija o. E no even happen for Africa. Na for Philippines. Me I never go there before but I dey see dis name for Bible. The thirty eight year old papa sabi find woman well well. As im dey find woman, na so im wife dey fight am everytime. 

According to wetin deir neighbour tell Police, " dis family dey fight eh,  no friday dey pass wey Oga and madam no dey fight"  Dis man like woman sotay dem don drive am comot for two places wey him dey work, because him office
colleagues wey be fine girls  na so so chase im dey chase dem for inside office. 

For dis particular night now, im wife wey don tire for dis kind woman wrapper man, come dey argue with am. Na so de man come vex dey beat de wife. When de beating no do am now, e go carry Saw to come Saw the woman leg. Aa im dey try to cut the leg, na so de woman de cry, cry, cry o until deir eleven year old girl no fit take am again. De girl just run enter kitchen go carry sharp knife comot. As deir papa dey try to cut her mama leg, na so she just run chook de knife inside her papa chest. 


When e say say im daughter don chook am knife, im come run comot outside. As e dey run go, na so e go fall down for grass kpeme at once. The small girl come dey run go knock for neighbour door say make dem come help so dat deir papa no go kill mama o. When neighbor dem come outside,  come see say de papa don die finish for grass, dem kookooo  call Police for de girl.
Dis ting wey oyibo call Domestic Violence eh, e don kill plenty people o.

2 comments

  1. Replies
    1. Hmm no be small ting sister Dayor. de kain tings wey person dey see now eh, e be like say dis world don end finish o.

      Delete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.