Na Timaya And Empress Njamah Tory


People wey go for Tuface Idibia him Birthday Party wey hold for Lagos dem see Timaya and Empress Njamah dey dance together o. Dis na their first friendly time since wey dey break up. After dat break up, we know say Timaya come dey talk say make Empress give am back the car key for the motor wey him buy dash Empress. Sotay Timaya come call Empress Thief. Come say Empress hand dey quick well well. The thing vex de Actress well well o.

Since dat time till now, people never see dem together o. Sotay Timaya come born pickin with im baby mama this year. Dat 18th of September wey be Tuface Idibia Birthday Party, no be say dem come the Party together o. Empress first reach there before Timaya, she kuku find her
place sidon with other Nolly wood Actors dem. as Timaya enter come see say Empress dey there, him go whisper something for her ear. She quick quick understand wetin him tell am. The two come stand up dey dance together. I no know sha o. Na like dis I see the story for Nigeria films dot com. Abi na happy re union we go call am?

No comments

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.