Saudi Arabia Don Drive Some Pilgrims Comot

 

De Govment of dis country say wetin make dem drive some of dis women pilgrims go back home na because say dem no follow de law. Their law for dat Kingdom be say, any woman wey wan come for Hajj, if e know say im age never reach 45, make e kuku carry one man pikin follow am come.

No be any kind man
e fit carry o. Na man wey get wetin dem call authority. *Well me I come tink say dat man suppose be de woman husband o.* Dat law don dey since o. Na dis year wey dem come vex say " e don do" Na so any woman wey never pass 45 years and e no carry man pikin follow am come just dey turn back go home.

De ting be say no be only Nigerian women dem drive comot o. Even women from Oyibo l;and wey disobey dis law na so dem ready to send dem all go home.
Enhanced by Zemanta

1 comment

  1. I knoω this if off toрic but Ι'm looking into starting my own weblog and was wondering what all is needed to get set up? I'm assumіng hаving a blog likе youгѕ would cost а prettу penny?
    I'm not very internet savvy so I'm not 100% sure. Any suggestions or advice would be greatly appreciated. Many thanks
    my webpage: Hotels In Amsterdam

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.