Man Pikin Don Turn To Car Seat O



Dis Africa man don tire with life for dis African continent sotay him come ready to do anyting wey go just carry am comot from him country Guinea. As e tink finish, e come go plan with two Moroccans on how dem fit help am run escape. As you see am inside dis car, na so dem take construct space for am like car seat. Another man come climb sidon on top am like
car seat. The driver of de car come go sidon for im side too like say na only two of dem dey inside de motor. 

As police come stop de car, na so one take eye shine inside de car well well, come see say e be like say some people suppose come down so dat dem go check de motor well well. Once de man wey sidon on top jump come down, na so police come see another man wey dem don dress like car seat  come dey shine eye like human- car -seat.

Wetin person no go see for dis life? na wa o.

No comments

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.