Police Wey Catch Cynthia Osokogu Killers Dem Don Smile O



Friday wey just pass so, wey be September 21, The National Orientation Agency Come Reward The Policeman dem wey investigate sotay dem come catch the yeye men wey Kill the Fine Cynthia Osokogu. 

The Directof For National Orientation Agency say wetin make am come honour dis policemen dem na because sau dem work well well. If no be dem, we for still deyn hear say they never find the people wey kill Cynthia. You know say na so e dey happen for our Naija. Wen dem kill Person, Police go dey say dem still dey look for the killers until we forget about the person wey die. For dis Cynthia case, everybody happy with Nigerian Police because sharp sharp dem investigate, sharp sharp dem catch the yeye men dem and sharp sharp dem carry dem go court.

The Seven Police Officers na:


  1. ACP Damien Okoro
  2. DSP Imoh Gregory
  3. ASP Mariam Ogunmolasuyi
  4. ASP Agbaje Yakubu
  5. Inspector Edo Joseph
  6. Sergeant Patience Biokoro
  7. Sergeant Frank Okorobon.

    The Director General For National Orientation Agency come talk say wen person do well, make dem tell the person say "you don do well."

Enhanced by Zemanta

No comments

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.