Na Wetin Dey Happen To Mama?

English: Demonstration of bad food hygeine in ...
English: Demonstration of bad food hygeine in stored foodstuffs in a refrigerator (Photo credit: Wikipedia)
Abeg who know Wetin dey happen with our president wife? Dame Patience Goodluck Jonathan,  E don stay wey we hear say she no well, some people say na food poisoning, others say na appendicitis wey come burst inside her belle. Some of us come even hear say she don well, say na the German Doctor dem say make she wait small time before she return back home. After dat
one, dem come dey say Oga President don change all her meguard wey dey guide her for there because their mouth come dey run too much.
 Time don dey go, wetin come make wey she never return till now? Abi she dey Aso Villa already? Make we know now abeg. Una know whether she don return?? No be Amebo I dey do abeg. After all na she come be like mama for Nigeria. Who sabi abeg?

Enhanced by Zemanta

2 comments

  1. lol...ur pidgin write up toh bad...i like!
    abeg visit my blog
    www.somewhereinmoscow.blogspot.com

    ReplyDelete
  2. @Ada Tank you for dis comment o. I go visit you.

    ReplyDelete

You do well as you read am. Oya add wetin you tink.